Friday, March 11, 2011

MY ABSENCE FROM NAWA 4 U :(

My Brothers and sisters. abeg make una no vex for me. Lots of u guys have been sending me emails asking me when i go put up another news.....Just that I have been very very very very busy here in Naija......and una know as our internet connection for here dey nah....before person go even open internet connection for hia ehhn....na WAEC.....and also i no come naija to come dey open teeth for people face nah....I'm here to hustle. cos this place na real jungle ehh.....na so so dinasours full for here ohh....no barneys at all at all :)

BUT I DEY PROMISE UNA SAY BY NEXT WEEK I GO RESUME MY POSTINGS...AND TRUST ME I HAVE SOME REAL FUNNY PICTURES AND CRAZY NEWS EHH.......

Nothing do all of una jare...

No comments:

Post a Comment