Wednesday, March 16, 2011

BLACKBERRY MADNESS IN NAIJA EHH



Okay so now in Naija, the only thing thing wey dey reign now na blackberry.....when my friends been dey tell me when i been dey yankee, i tot it was a  joke......but mehnnnnnnn, this whole blackberry thingy is on another level here i swear...its like a freaking drug addiction. if u no get blackberry, then that mean say u never even land......Chai.. the kind things wey i dey see ehhn.....these days sef, nobody dey give out number anymore....cos all u just need na that so called BB Ping stuff.

And u suppose trust our Naija guys nah.....As in ehhn,  boys don use Blackberry dey enter a lot of chicks. All u need do na to tell them say u like them and u go buy blackberry for them tomorrow.......and before u know wetin dey happen, dem don open leg saraaaaa for u. and the painful thing be say sometimes only very few of the babes go actually dey lucky to even finally get the blackberry...........the onesd wey dey reign now na the Bold 2 model......na so so bold 2 Bold 2 u go just dey hear everywhere. But the chairman of them na the Blackberry Torch......Infact ehhn, if u hold that one for hand ehhn, na so people (both men and women, depending on the one wey u want...ha ha )  go just dey ready kiss ur black nyash anyhow, and at any point in time ehh ;)

Its so so so funny cos once upon a time, Nokia was the number 1 phone in Naija, but now na them wey i dey even pity pass......Cos a new Canadian product is in town, and his name is BB, and he's here to stay for good ;)

2 comments:

  1. Hahahahah... 9ja for show. Once we follow a trend, we follow it to the end. Have you seen the poster for the movie BBB( Black Berry Babes)...I died when I saw that. SMH.Only in Nigeria!

    ReplyDelete
  2. And dont forget the lovely bb perfume hahahah, poverty mentality.

    ReplyDelete