Tuesday, July 20, 2010

SOLDIERS BATTER LASTMA OFFICIALS.........HA HA HA

umm LOL......WOW...WOWZERS

I know some of una no go know wetin LASTMA be, since una never enter Naija in a long time. Well, Its an organization that was formed in Lagos some yrs ago in order to handle all road and traffic related issues. But for a while now, dem don dey threaten and tourment lagos citizens so badly, such that even a driver will prefer to be caught by a police, instead of LASTMA peeps. I even witnessed their surroption and crazy brutality to some bus drivers....infact no be small thing ohh.
Anyways this LASTMA official right here and two of his colleagues decided to go tow a trailer wey been dey obstruct traffic. Not knowing the owner of the trailer don already contact im military guys.....Na some army and navy guys just show. I hear say if u see beating wey dem give these LASTMA guys ehhn...even u self no go gree make person beat ur enemy like that....See am for urself nah.....the picture is self explanatory :)
Opefully this will make these so called LASTMA peeps kool down small, cos their own gri-gri don too much jare :)

but..but...DAYUM......I NO KNOW BEEN KNOW SAY E GET THE KIND BEATING WEY GO FIT DEFORM PERSON FACE LIKE THIS OHH  :)

(pmnews.com)

No comments:

Post a Comment